Expectations High for Nigeria new Presido Tinubu

Some politicians wey dey close to the new Presido Bola Ahmed Tinubu don tok se him administration go succeed from day one.

One of dem na Senior Advocate of Nigeria and chieftain of the All Progressives Congress, Babatunde Ogala.

The Senior Lawyer tok se him believe se Presido Tinubu don already gather the team wey go work wit am.

Meanwhile, Nigerians don set agenda for Presido Tinubu.

Pipu for the streets of lagos follow our correspondent Chukwuemeka Obioma tok and dem se dem want make the new Presido make sure se security tight for we country, make he create kajad environment for businesses to do well for we country.

Pipu tok se make the new Presido empower youths by se job yanfu, make him provide more infrastructure and form kajad policies wey go transform wi economy.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x