Nigerian singer, Tems don become the first female Nigerian artiste to win Grammy Award. Tems pick the Grammy Award for ‘Best Melodic Rap Performance’ on top her role for the 2022 hit song: “Wait for U”, wey she perform with Drake. Burna Boy for him side, lose the ‘Best Global Music Album’ plus the ‘Best Global Music…
One Chicago prosecutor don drop sexual abuse and assault charges against R Kelly. The prosecutor wey be Kim Foxx say her office no go pursue the case again and dem go ask the judge to throw wey the case. The charges plus allegiate on top R Kelly don de dey since 1998.
Actors Guild of Nigeria don elect Kate Henshaw as National Public Relations Officer. Abubakar Yakubu wey be AGN National Secretary tell tori people this one for inside Lagos. Yakubu explain say AGN members elect Kate for one special National Executive Council meeting.
Peace Anyiam-Osigwe family don confirm say she don die. The family describe Peace wey be founder of Africa Movie Academy Awards and Presido for Association of Movie Producers as creativity symbol. Peace come from popular Anyiam-Osigwe family for Nkwerre, Imo State, and she still come be the only girl for family of eight children. She get degree…
Popular Nigerian writer, Chimamanda Adichie don collect chieftaincy title for her village Adichie wey come from Abba community for Anambra State collect the title of ‘Odeluwa Abba’. Odeluwa title, mean person way de write for the whole world. The title come make Adichie the first woman to collect chieftaincy title for Abba community. Chimamanda Adichie wey her…
P-Square don entertain Labour Party supporters for Peter Obi campaign for Port Harcourt, Rivers State capital. Obi wey be Anambra State former governor come the rally with him wife, Margaret plus other Labour Party Oga dem. You fit still remember say, Rivers State Governor, Nyesom Wike promise Obi say him go give am logistics when him to…