Court sentence Osun state Hotelier Rahmon Adedoyin to death by hanging.

Court don sentence the owner of Hilton Hotel and Resort for Osun State, Rahmon Adedoyin to death by hanging.

Na the hotel dem tek kill Timothy Adegoke wey be  post-graduate student of Obafemi Awolowo University.

Out of eighteen charges wey dem knack Adedoyin and six other pipu, the Chief Judge of Osun State, Justice Adepele Ojo find Adedoyin guilty of seven charges.

Justice Ojo of the Osun State High Court com slam death sentence give Adeniyi Aderogba ans Oyetunde Kazeem.

Aderogba abd Kazeem dey among staff wey dey on duty for Hilton Hotel and Resorts the day wey dem kill Adegoke after him check in as guest.

However, the Court discharged and acquit three other defendants for the case, wey their name na Magdalene Chiefuna, Lawrenece Oluwole and Adedeji Adesola.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x