FCT Indigenes dey demand for equal status as oda 36 states of di federation

Indigenous pipu of di Federal Capital Territory, Abuja dey demand for equal status with di thirty-six states of di federation.

Sake of di judgment of di Presidential Election Petitions Tribunal, wey hold se FCT no get any special status and dem suppose treat am like oda states wen e com to value of electoral votes.

Abuja indigenes now dey demand to get governor, three Senators and House of Representatives.

Di Tribunal Justices give di ruling for di question of weda to declare candidate winner for presidential election must win twenty-five percent of the votes in the FCT.

On di development, former presidential tok tok persin former Vice Presido, Yemi Osibanjo, Laolu Akande, tok se di Independent National Electoral Commission get plenti work to do to regain public trust for di electoral process.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x