Island area for Lagos go experience flood

Dem don warn de residents of Lekki-Ajah axis for Lagos State about di flood disaster, forsake of di heavy rainfall and di plenti water wey go come from dams.

Oda areas wey go still experience dis flood na Alagbole, Meiran, Maidan, Kara, Isheri-Olowora, Agiliti, Owode-Onirin, Owode-Elede, Agboyi, Ajegunle, Itowolo, Majidun, Ibeshe, and Baiyeku.

Di Permanent Secretary for di office of Drainage Services and Water Resources, Lekan Shodeine, tok se di water wey dem go release from Oyan Dam for Ogun-Osun River Basin Authority fit affect part of Lagos.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x