NEC dey hold meeting ova growing cost of living

Di National Economic Council don dey do meeting today to discuss di situation for di country as e tek concern di growing cost of living.

Na Vice Presido Kashim Shettima dey chair NEC and di thirty-six state governors na member.

Reports from Abuja se stakeholders from di World Bank and other agencies of government follow dey for di meeting.

Di Council bin call di meeting to discuss di impact of di removal of petrol subsidy, and di hardship wey Nigerians dey face as cost of living don high.

One Professor of Strategy and Development, Anthony Kila, tok se di NEC meeting good o but di meeting dey come late after damage don already dey.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x