Oga Presido Buhari don give National Honours to 449 individuals

Oga Presido Muhammadu Buhari don give National Honours to 449 Nigerians plus foreigners.

Oga Vice Presido Yemi Osinbajo plus Oga Presido Buhari Chief of State wey be Ibrahim Gambari still attend the event wey shele for the International Conference Center for inside Abuja.

Oga Presido Buhari come still tok say him belle sweet am say as many Nigerians dey face hardship, some people still de do their best to make sure Nigeria better for everybody.

World Trade Organisation Director-General, Ngozi Okonjo-Iweala; United Nations Deputy Secretary-General, Amina Mohammed; Oga Senate Presido, Ahmed Lawan; Chief Justice of Nigeria, Olukayode Ariwoola, plus former Chief Justice of Nigeria, Tanko Muhammad receive the Grand Commander Order of the Niger award for the event.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x