Oga Vice Presido, Osinbajo say him no get road accident for Abuja

Oga Vice Presido, Professor Yemi Osinbajo say him no get road accident for Abuja as some media houses take report.

Instead, Oga Vice Presido Osinbajo say him de on him way to Nnamdi Azikiwe International Airport yesterday when him convoy go run enter place wey accident happen along Airport road.

Professor Osinbajo come still tok say him stop him convoy, go still instruct him security plus medical teams to help comot the victims from the place wey the accident happen.

Oga Vice Presido for one message for him Twitter handle tok say dem move victim of the accident go Nigerian Air Force Base hospital for treatment.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x