Oyo State Police Command dey find Mukaila Lamidi, the Chairmo of Park Management System.

Operatives of the Oyo State Police Command don go raid different place for Ibadan dey find di Chairmo of Oyo State Park Manangement System, Mukaila Lamidi.

Police ransack Lamidi house and dem see guns, bullets and machetes.

Dem know Lamidi for the town as Auxiliary.

Auxiliary bin don run commot from prison but police arrest some of him men wey dey police detention now.

The Police Public Relations Officer, Osifeso Adewale, tok se na seventy-eight suspects naim police arrest.

Adewale allege se the suspects bin dey plan to cause gbege for major parts of Ibadan.

Naim com make dem close motor parks and garages for Ibadan and other parts of Oyo State.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x