Chief of Defence Staff General Lucky Irabor, say dem don arrest people wey kill worshippers for Saint Francis Catholic Church for Owo inside Ondo State. Chief of Defence Staff confirmed this one for one meeting wey him get with news editors plus media executives for Abuja. General Irabor come still promise say dem go parade the suspects…
Ondo State Security Network Agency wey we know as Amotekun Corps say dem don arrest forty-five criminals for inside different local governments inside the state. The corps say dem arrest the suspects for different different offences like armed robbery, kidnapping, rape plus attempted murder. Adetunji Adeyeye wey be the Commander for the security outfit, tell tori people…
Amotekun Corps operatives for inside Ondo State don arrest some suspects for the terror attack on top worshippers for Saint Francis Catholic Church inside Owo. Amotekun Corp Commander, wey be Adetunji Adeleye, who tell toli people this one for the State capital Akure, no come tok the numbers or the suspects their names. As that one dey…
Funeral mass don hold for forty worshippers wey terrorists kill for Saint Francis Catholic Church for Owo, Ondo State The burial mass start after they bring the coffins wey carry the dead body enter the venue wey be Mydas Resort Owo. Ondo State Governor, Rotimi Akeredolu plus other ogbonge people attend the mass.
Lagos State Governor wey be Babajide Sanwo-Olu don visit Rotimi Akerodolu wey be Ondo State Governor on top terrorist attack wey happen for Saint Francis Catholic Church for Owo. People wey follow for the visit na Ogun State Governor, Dapo Abiodun. From Akure, Governor Sanwo-Olu and Governor Abiodun join Governor Kayode Fayemi of Ekiti State for APC…
Federal Government don blame ISWAP for Saint Francis Catholic Church terror attack wey happen for Owo inside Ondo State. Person wey talk this one na Minister for Interior, Rauf Aregbesola plus the Inspector General of Police, wey be Usman Alkali Baba, as they follow State House Correspondents talk after National Security Council meeting for Abuja. Minister of…