Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu don meet Atlanta Mayor for United States of America. The Governor meeting with Mayor Andre Dickens na to take renew the relationship between Lagos and Atlanta. Governor Sanwo-Olu for one short post for Facebook, tok say Lagos and Atlanta don enjoy more than fifty years of relationship. Governor Sanwo-Olu still tok for…
The Federal Government move to transfer Abba Kyari go United States of America don fail for Federal High Court for inside Abuja. Justice Inyang Ekwo for him ruling, throway the case wey Attorney General of the Federation and Minister of Justice Abubakar Malami file for the court say the case no carry weight. Abba Kyari lawyer wey…
NASA don ready to launch new moon rocket The Moon rocket wey dem call Space Launch System na the most powerful vehicle wey NASA don develop. The rocket so go up from Kennedy Space Centre later today.
One Police Oga don loose him job on top Texas shooting for US. They been accuse the Police Oga say police response de slow when man wey carry gun enter one school, kill 19 children plus 2 teachers. The school local board vote together to sack Pete Arredondo who don de leave since June.
Nigeria and US don sign agreement to return over 23 million dollars wey Abacha steal The agreement signing ceremony so been take place for Minister of Justice plus Attorney General of the Federation Abubakar Malami office for Abuja. Malami sign for Nigeria government side while U.S Ambassador to Nigeria, Mary Beth Leonard sign for the U.S government.
China don tok say US Speaker Nancy Pelosi visit to Taiwan de dangerous. China accuse Pelosi wey be the most senior US politician for twenty-five years to visit the island, say she dey play with fire. Pelosi say her visit to China na to honour America commitment to support Taiwan democracy.