TUC wan make FG increase minimium wage to two hundred thousand naira

Di Trade Union Congress tok se e dey expect di Federal Government to start to ready to give tax holiday for workers, as part of measures wey go help absorb di shock of petrol subsidy removal.

TUC Presido, Festus Osifo, tok se oda things wey di government fit do short time na to increase di cost of living allowance and minimium wage for workers

Festus Osifo tok se di Organised Labour still dey demand for two hundred thousand naira as increase minimium wage.

Di TUC Presido, dey tok for one television programme se serious discussions dey go on, about di development if cheap Compressed Natural Gas as anoda way for petrol in di long term.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x