APM close their case for Presidential Election Petition Tribnal wit one witness.

The Allied Peoples Movement don close their case for Presidential Election Petitioner Court for Abuja.

Di APM bin start and close their case within di space of two and half hours wit one witness wey testify to favour dem.

Aisha Abubakar, wey be di witness, tok se she be di APM Assistant Welfare Officier and still adopt  five written statement on oath.

Di APM dey challenge di election victory of Presido Bola Ahmed Tinubu and Vice Presido Kashim Shettima.

Di petitioner claim se di APC candidates nor qualify to contest di election on di ground se Shettima get double nomination.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x