AYOKUNLE BAILEY COLLECT LIFE IMPRISONMENT FROM THE LAGOS STATE DOMESTIC VIOLENCE AND SEXUAL OFFENCES COURT FOR SE HIM DEFILE FIFTEEN-YEAR-OLD GIRL

The Lagos State Domestic Violence and Sexual Offences Court don sentenced one AYOKUNLE BAILEY to life imprisonment for se him defile one fifteen-year-old girl.

Justice ABIOLA SOLADOYE found BAILEY guilty of di crime wey him commit on December 18, 2017, inside uncompleted building around Alaka area of Mushin.

Na team of lawyers from di Lagos State Ministry of Justice, wey OLUSOLA SONEYE and OLUFUNKE ADEGOKE led naim handle the prosecution case.

Dem tell di Court how di underage victim go visit her grandmama, and when she dey play wit other children outside di house, the convict deceive enter one uncompleted building where him comit di crime.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x