Chief Magistrate no show court for Seun Kuti case today

Chief Magistrate ADEOLA OLATUBOSUN of the Yaba Magistrate’s Court np show for cut today and na wetin delay the case of Afrobeat musician Seun Kuti.

Chief Magistrate OLATUBOSUN bin don grant two orders wey make Seun Kuti stay prison for six days after him surrender himself to police one week ago.

SEUN KUTI land for trouble with authorities of the Nigeria Police Force after he dem see am for online video dey slap police officer ontop the Lagos Third Mainland Bridge.

When the matter com up for court today, dem inform parties wey dey involved for the matter se the Chief Magistrate OLATUBOSUN no dey, and adjourned the case till tomorrow, May 24, 2023.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x