Court fix date to tek hear case wey Diezani Alison-Madueke file against EFCC

Federal High Court for Abuja don fix October 23 to hear di case wey former Minister of Petroleum Resources, Diezani Alison-Madueke file against di Economic and Financial Crimes Commission.

Diezani Alison-Madueke dey challenge di court order wey she obtain from EFCC sake of di final forfeiture of her assets wey dem seize.

Justice Inyabg Ekwo fix di date after Alison-Madueke lawyer, Benson Igbanoi and di EFCC lawyer, M.D Baraya finish the filling of their processes.

Di EFCC bin don tok se e reach one hundred and fifty-three million US dollars and eighty property wey dem recover as dem dey suspect am to be wetin Alison-Madueke gain from crime.

Di anti-graft agency bin put Alison-Madueke assets wey dem seize for public sales as wetin dem forfeit to di Federal Government.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x