DSS dey try to stop allege violet protest across Nigeria

Di Department of State Services don tok se dem know about di allege staged violent protest by some pipu and group across Nigeria.

Di DSS se dis protest plot suppose to discredit de Federal Government and Security agencies on top various socio-economic matters for di country.

Di DSS tok-tok pesin, Peter Afunanya, tok am for one statement se politicians join dis alleged plotters

Afunanya allege se the unname of de politicians dey mobilize unsuspected student leaders, ethnic associations, youth and disgruntled groups for di action wey dem plan.

He tok se di DSS don identify di ring leaders of di plot, and dem dey monitor dem to stop dem so dat dem no go put di Kontri into lawlessness.

Following di development, di DSS tok-tok pesin tok se dem don advice di Vice-Chancellors of Universities and Heads of other Tertiary Institutions to discourage their students make dem no do anything wey go threaten public peace.

He still tok se make parents and guardians advise their pikin and make dem avoid anything wey dey against law and order.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x