FG declares Monday, July 11, and Tuesday, July 12 as public holidays for Sallah celebration

Federal Goment don declare Monday and Tuesday next week as public holidays for Sallah celebration.

Di Minister of Interior, RAUF AREGBESOLA, naim announce di Eid-El-Fitri public holidays for inside statement wey Permanent Secretary, SHUAIBU BELGORE sign.

AREGBESOLA call on Muslims to kontinu to dey practice love, kindness and sacrifices, as di Holy Prophet Mohammed go want am. 

Him still give assurance se Oga Presido President MUHAMMADU BUHARI administration dey committed to di security of life and property of all Nigerians.

Di Minister say make all citizens no lose guard and make dem ring bell for strange people wey enter their community, plus say everybody inside we kontri dey responsible for the security of their life and property.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x