Gov. Samuel Ortom beg Presido Buhari make him no japa go Niger Republic.

Governor Samuel Ortom of Benue State tell Oga Presido Muhammadu Buhari not to relocate go Niger Republic when him comot for office next week.

The Governor Ortom tok se make Presido Buhari stay for we country Naija to helep the incoming administration for federal level.

Ortom tok se even though Presido Buhari carry Naija from ontop to bottom, make Naija pipu no hold am for belle.

The Benue State Governor na one of Presido Buhari strongest critic wey tok se him don forgive am.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x