INDABOSKY fight back, as Anambra State Goment demolish him church building for Onitsha

Officials of di Anambra State Goment don go demolish di church building of controversial preacher, Prophet ODUMEJE, wey pipo know as INDABOSKY.

ODUMEJE Mountain of Holy Ghost Intervention and Deliverance Ministry dey along Nwangene stream for di commercial city of Onitsha.

Di state goment bin don mark di building for April dis year for alleged obstruction of one drainage channel and in line wit di urban renewal plan of Governor CHARLES SOLUDO.

Photo from di demolition site show as ODUMEJE dey confront soldiers and other security operatives wey dey provide cover for di demolition officials and their equipment.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x