Some pipu wey dem rescue for church basement inside Ondo State no gree go house wit their family.

Police don tok se some of the seventy-seven people wey dem rescue from one church basement for Ondo Town, Ondo State, come from other states.

Na di Police tok tok persin of the Ondo State Police Command, FUNMILAYO ODUNLAMI, confam am, plus se some of di pipu wey dem resue no gree go house.

ODUNLAMI, wey follow ua tok for phone interview se di pipu wey dem rescue dey tok se dem no go comot from the state Criminal Investigation Department inside Akure until dem release their church pastors.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x