INEC CHAIRMO DON GO OSUN STATE GO MONITOR PREPARATION FOR THE GOVERNORSHIP ELECTIONS

The Chairmo of di Independent National Electoral Commission, Professor MAHMOOD YAKUBU, don kontinu him assessment visit to Osun State for di second day.

Professor YAKUBU led team of INEC top officials to monitor preparations for di governorship election wey go happun for Osun State on July 16, 2022.

Professor YAKUBU and members of his team visit di INEC office for Ife North Local Goment Area, where him helep to give voter cards to ten people wey com for collection.

The INEC officials still visit di palace of di Ooni of Ife Oba ADEYEYE ENITAN OGUNWUSI, for Ile Ife, where di monarch asked di INEC Chairmo to tell politicians to play by di rules.

Professor MAHMOOD YAKUBU com give di Ooni of Ife assurance se di Commission go make sure se dem count di vote of people.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x