IPMAN call on Presido Tinubu to Intervene for di allegate se NNPCL no gree release fuel to petrol marketers

Di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria dey boil for action against di Nigerian National Petroleum Company Limited for allege withholding of petrol orders by em members for more than six months.

IPMAN don call on Presido Bola Ahmed Tinubu to do something wey go save di country from anoda petrol scarcity if NNPCL no gree to deliver petrol wey their members bin order.

Di Suleja/Abuja branch Chairmo of IPMAN, Yahaya Alhassan allege inside statement se fi NNPCL use money wey petrol marketers pay to tek import fuel but still yet dem no get supply.

Him allege se some of em members get up to four thousand outstanding petrol order ttickets wey worth over seven hundred million naira each wit di NNPCL.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x