Lagos State Deputy Governor, Obafemi Hamzat no gree se him renounce him Nigerian citizenship

Di Deputy Governor of Lagos State, Obafemi Hamzat don deny say him renounce him Nigerian citizenship so that him go get USA citizenship.

Hamzat deny am wen him dey react to one witness testimony for di Lagsos State Governorship Petition Tribunal last week.

Him tok se reports of di court proceedings wey claim se him dump him Nigerian citizenship no be wetin really happen for di Tribunal.

Di media office, di Deputy Governor for inside statement tok se documents wey one US immigration lawyer, Olubusayo Fasidi tender to di tribunal dey empty and e no prove se him apply for US naturalization.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x