Lagos State don file manslaughter charges against the driver wey drive BRT bus enter train

Lagos State Government don file manslaughter charges against the driver wey drive BRT bus enter train wey de move for Ikeja

Lagos State Government drag the driver, wey dem identified as Osibanjo Oluwaseun, on top sixteen counts of manslaughter before Justice Oyindamola Ogala before the State High Court in Ikeja.

The Lagos State Director of Public Prosecutions, Babajide Martins, allegiate say the BRT driver’s carelessness cause three persons death and leave other people with injuries.

Osinbajo Oluwaseun tell court say him no dey guilty and the court come adjourned the matter till May 26 and June 16 and 28, 2023 for trial proper.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x