Lagos State Government confirm award of multi-million naira for mass burial of victims of October 20, 2020 EndSARS protest

Di Lagos State Government don confirm se dem give contract of over sixty-one million naira to tek do mass burial of victims of di EndSARS protest wey happen for October 2020.

Di Ministry of Health confirm se dem give out di contract on July 19, wey cover one hundred and three unclaimed bodies from di protest of nearly three years ago.

Di Lagos State government tok se di victims no bi di peaceful protesters wey soldiers and police open fire for on October 20, 2023 for Lekki toll gate.

Instead, di Permanent Secretary of di Ministry of Health, Doctor Olusegun Ogboye, claim se di bodi wey dem wan do mass burial for dem pick dem up from different areas inside Lagos.

Doctor Ogboye tok se di areas na Fagba, Ketu, Ikorodu, Orile, Ajegunle, Abule-Egba, Ikeja, Ojota, Ekoro, Ogba, Isolo and Ajah.

Di Lagos State Government stand ground se nobody die for di Lekki Toll Gate shooting on October 20, 2020 wey cause violence during di EndSARS protest for police reforms.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x