More questioning don dey follow di mass burial of EndSARS protest victims

Di mass burial of victims of di EndSARS protest for Lagos State don dey make many dey question the roles of major actors play.

Adesina Ogunlana wey be one of di lawyers wey represent victims of di EndSARS protest for di Lagos State Panel of Inquiry, tok se di state government confirm se pipu die all ova di city if Lagos for October 2020.

Ogunlana tok se as di Lagos State government keep ova one hundred unclaimed dead bodi of victims, e show se Nigerians no fit trust pipu wey dey for government.

Di former Chairmo of di Ikeja Branch of di Nigerian Bar Association, dey question di contract of sixty-one million naira for mass burial for unclaimed dead bodi.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x