Nigerian army find one abducted Chibok school girl

Troops for the 26 Task Force Brigade, don find one Mary Ngoshe, who the the Nigerian Army believe say na one of the students for Government Girls’ Secondary School, Chibok for inside Borno State wey Boko Haram kidnap for 2014.

Nigerian Army confirm this one on top their Twitter handle.

The army tok say dem find Ngoshe with one pikin wey dey believe say na her own when dem de do one patrol around Ngoshe for Borno State.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x