Oga Presido Buhari appoint 7 new ministers

Oga Presido Buhari don appoint seven new ministers.

Presido Buhari write letter to the Senate say make dem confirm the ministers wey him nominate.

Senate Presido Ahmad Lawan na him read Presido Buhari letter at Senate sit today.

Them be Henry Ikechukwu, Umana Umana, Ekuma Joseph plus Goodluck Obia.

Others na Umar Yakub, Ademola Adegorioye plus Odo Udi.

The new ministers go replace ministers wey dey for Oga Presido Buhari’s cabinet wey resign to contest for other position.

Some wey resign na Rotimi Amaechi, Godswill Akpabio, Ogbonnaya Onu plus Chukwuemeka Nwajiuba who contest for presidential primary.

Others na Uche Ogar plus Tayo Alasoadura who contest and still lose APC senatorial primary.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x