Oga Vice Presido Yemi Osinbajo don tell APC Governors make dem try end ASUU strike

Oga Vice Presido Yemi Osinbajo don tell APC Governors make dem try end the six-month ASUU strike.

Oga Vice Presido tok tok person wey be Laolu Akande tok this one for one statement.

Akande tok say the APC governors come visit Oga Vice Presido to take know how him body be after him do knee surgery last month.

Oga Vice Presido wey tok say Nigerian doctors de do well for the country, come still tok say e de painful say doctors not fit do advert to showcase their good works.

Oga Vice Presido plus the Governors dem come still discuss about the ASUU matter.

Osinbajo come still tok say make efforts de to take tackle economic matter plus ASUU strike.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x