PENGASSAN TOK SE FUEL YAPA INSIDE WE CONTRI WEY GO LAST FOR 30 DAYS

Di Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria don tok se plenty petrol dey wey go last for over thirty days.

PENGASSAN Presido, ERNEST OSIFO, tok se information wey dem gather from relevant agencies show se petrol inside Nigeria now dey above two billion litres.

OSIFO se di reason for di current scarcity of petrol for filling stations na mata of distribution and pricing, and di Nigerian National Petroleum Corporation no dey lift petrol from em depots.

ERNEST OSIFO,tok se dem dey try to make sure se dem supply plenty petrol at di right price to cover di cost of marketers.

The PENGASSAN Presido still tok se if dem comot petrol subsidy, now dem go dey sell am for over five hundred naira per litre.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x