Peter Obi go visit Professor Soyinka

Labour Party presidential candidate, Peter Obi don visit Nobel Laureate, Professor Wole Soyinka, on top wetin him call unnecessary mix-ups about the relationship between literature sabi person and him supporters wey people know as OBIdients.

Obi wey describe Soyinka as papa wey him respect for, say the visit so na to settle disagreement between Soyinka and the OBIdient family.

The former Anambra State Governor tok this one one tweet.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x