Presido go come back to Nigeria before Sallah

Presido Bola Ahmed Tinubu suppose comme come back tomorrow, so as to celebrate di Muslim festival of Eid-El-Kabir.

Presido Tinubu comot Abuja go France lasr week for di Financial Pact Summit inside Paris and him suppose come back to Nigeria on Saturday but di Presido divert to di United Kingdom for wetin him media aide say na for private visit.

Close source to di media naim confirm say Tinubu to touch down Lagos on Tuesday where him dey plan to spend di sallah holiday.

Di report say Presido advance team don already dey prepare to enter Lagos ahead of Tinubu arrival.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x