Presido Tinubu go travel him first official oversea waka to France

Presido Bola Ahmed Tinubu go travel outside di country on Thursday dis week wey go make am him first official official foreign waka since him become presido three weeks ago.

Na di Special Adviser to di Presido ontop Special Duties, Communication and Strategy, Dele Alake announce di overseas travel plan for inside statement.

Alake tok se Presido Tinubu dey travel go France to go attend di Paris Summit for New Global Financial Pact wey go hold for two days from June 22 to June 23.

As Presido Tinubu dey Paris, Alake tok se him go join other leaders to review and sign New Global Financial Pact then come back to Nigeria on Saturday, June 24.

For inside the statement, di proposed agreement place weak countries wey dey face Covid-19, climate change and energy crisis for di priority list wey need support and investments.

Oga Presido Emmanuel Macron of France na di host of di summit wey for di prestigious Brongniart Palace, wey be home to di Paris Stock Exchange.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x