Rwanda and Cameroun Presidos make major shift for their Kontri Millitary

Di Presido of Rwanda, Paul Kagame, don approves di immediate retirement of eighty-three top military officers, with twelve generals.

Di Rwandan Defence Force don confirm di development as one of d major adjustment for di postings of top military commanders.

Dis move wey Presido Kagame don appear to be in work with di wave of coups blowing across Africa.

Kagame don dey for power for twenty-three years since 2000, and him still fit dey dere till 2034, if them follow di country’s constitution for 2015.

Also di Presido of Cameroon, Paul Biya, don approve change for di country’s Ministry of Defence.

Di ninety-year-old presido of Cameroon, wey don dey power for forty-one years, since 1982 announce di change for one decree.

Di changes include assigning di presidency to oversee the defence, navy, police, and air force staff.

Cameroon dey share part of boundary with Gabon wey di military plot coup wey overthrow Presido Ali Bongo on Wednesday morning.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x