Senator Shehu Sani say Presido Tinubu dey dismantle former Presido Muhammadu Buhari defective pillars

Human rights activist-turned politician, Senator Shehu Sani tok se jollification wey follow di actions of Presido Bola Ahmed Tinubu na becos of di actions wey past Presido Muhammadu Buhari no gree take.

The former Kaduna Central Senator tok se di eight years od di Buhari administration no sweet, plus tok se di former presido no dey fit tek decisions, him dey weak, he no get vision and him dey allow oda pipu dey lead di government.

Senator Shehu Sani tok se wetin dey happen now na gradual dismantling of wetin him call defective pillars wey di former presido rest ontop and waste him oppotunate and di time of di country.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x