South Africa government say dem go change law to take stop Putin arrest

South Africa government don tok say dem go change law to take stop Vladimir Putin arrest by International Criminal Court.

Early this year so, the Russia Presido bin get invite for South Africa, but arrest warrant wey ICC issue means say, them go arrest Putin if him come the event.

International Criminal Court bin accuse Putin say him commit crimes against humanity for the war wey de shele for inside Ukraine.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x