Trade begin de pick up again for Apongbon Under-Bridge

Trade don begin de pick up again for Apongbon Under-Bridge for Lagos Island even after government try make dem clear the area after fire burn for the area on March 23, 2022.

Lagos State Government plus the Federal Government been direct all people wey get structures under Apongbon bridge and other bridges wey de across the city make dem comot before Mach 31.

After more than six weeks wey the quit notice expire, Lasgidi FM’s Chukwuemeka Obioma visit the Apongbon Under-bridge and come dey report say business activities still de go on for the area.

Some of the traders wey speak with Obioma, say no dem get anywhere to go.

Them come still beg the state government make dem allow them to continue to de sale their market under the bridge.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x