UAE lift visa ban for Nigeria

Di Presidency tok se di United Arab Emirates don lift di visa ban wey dem place ontop Nigeria for almost one year.

Di Special Adviser to di Presido on Media and Publicity, Ajuri Ngelale confirm dis one for inside statement.

Ngelale tok se di visa ban lifting follow agreement between Presido Bola Tinubu and di Presido of United Arab Emirates, Mohamed Bin Zayed Al Nahyan on Monday.

Him tok se for di agreement, both Etihad Airlines and Emirates Airlines go resume flight operations into and outside Nigeria immediately.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x