7 political parties agree say dem go present joint candidates as APC don start to de screen people wey wan be President

7 political parties don agree say dem go present joint candidates as APC don start to de screen people wey don declare say dem wan be President.

The parties so na; New Nigeria Peoples Party, African Democratic Congress, Social Democratic Party, plus Allied Peoples Movement.

Others na; People’s Redemption Party, Labour Party, plus including the National Rescue Movement.

Some big name wey de the group na; Professor Attahiru Jega, Professor Pat Utomi; plus Senator Saidu Dansadau.

The tok tok person for National Consultative Front wey him name na Bello Bilikis, say dem reach the agreement under wetin him tok say na the Third Force Movement after about fifteen months of negotiations.

Meanwhile; all the twenty- eight presidential aspirants for APC go start their screening today.

APC been tok say dem go do the screening tomorrow, but dem come later cancel am for reasons wey dem no tok.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x