APC tok say dem go sale expression of interest and presidential nomination forms for 100 million naira

All Progressives Congress don set di price of its presidential nomination and expression of interest forms to one hundred million naira.

Di cost for di APC forms take sixty million naira pass PDP wey sale dia form forty million naira.

APC National Executive Committee approve the money for one emergency meeting wey dem do for Abuja.

APC National Publicity Secretary, Felix Morka, tok sey the party dem go sale nomination forms for fifty million naira

Morka tok say the party go sale nomination form for Senate for twenty million naira while dem go sale House of Representatives form for ten million naira.

Him still talk say State House of Assembly na two million naira while women and pipo wey de disable go pay for their nomination but their expression of interest forms na free.

 

 

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x