ASUU chairmo se make FG convert student loan to grant for poor students.

Di Academic Staff Union of Universities don ask di Federal Government to convert e students loan scheme to grants for poor students.

ASUU tok se na because se more ninety percent of students wey need financial support for their education fit pay back di loan.

ASUU Presido Emmanuel Osodeke, still tok se di government loan no fit meet di needs of more than one million students of higher education now.

Professor Osodeke se di way di structure of di loan be now go put heavy load ontop students wen dem dey graduate, and da one fit no make dem clear di loan two years after dem finish school.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x