Banks open for Lagos States as NLC dey start strike today

Banks for Victoria Island inside Lagos State open for business, even though di Nigeria Labour Congress declare two-day warning strike wey start today.

Lasgidi FM Correspondent Azuka Onwuzor wey visit some banks for Ajose Adeogun, Adetokunbo Ademola and Ligali Ayorinde streets, observed se customers dey go in and out of di banking halls.

E be like se di bank workers ignored di directive of di National Union of Banks, Insurance and Financial Institutions Employees to join di strike.

Lagos State Nigeria Labour Congress, Chairmo, Agness Sessi, don clarify se no be all bank workers go join di strike.

Sessi tok se some banks dey under di NLC and some wey no dey join di strike dey under di Trade Union Congress.

Still sef, the Lagos State Police Command don deploy operatives go different parts of di state sake of di public protests.

Lasgidi FM Najite Atirene see armed police operatives dem for around di Admiralty Toll Plaza, where di shooting of EndSARS Protesters happen for October 2020.

Di Lagos State Police Command tok tok persin, Benjamin Hundeyin confirm se di deployment if police operatives na to maintain law and order.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x