DSS tok se dem don charge suspended CBN governor Godwin Emefiele to court

DSS tok tok persin, Peter Afunaya, no tok wetin dem charge Emefiele for or tok which court dem file di charges.

Afunaya dey tok dis one hours after one Abuja High Court order di DSS to charge Emefiele go court or release am from detention.

Justice Hamza Muazu give di ruling for di case of fundamental human rights enforcement wey Emefiele through him lawyer, Joseph Daudu file.

Justice Muazu hold se di suspended CBN governor no fit continue to de dey detention if dem no charge am go court.

Di Judge still declare se di DSS not fit use di period wey dem tek dey detain Emefiele to dey find evidence against am.

Di Department of State Services tok se e don file charges for court against di suspended governor of Central Bank of Nigeria Godwin Emefiele.

DSS tok tok persin, Peter Afunaya, no tok wetin dem charge Emefiele for or tok which court dem file di charges.

Afunaya dey tok dis one hours after one Abuja High Court order di DSS to charge Emefiele go court or release am from detention.

Justice Hamza Muazu give di ruling for di case of fundamental human rights enforcement wey Emefiele through him lawyer, Joseph Daudu file.

Justice Muazu hold se di suspended CBN governor no fit continue to de dey detention if dem no charge am go court.

Di Judge still declare se di DSS not fit use di period wey dem tek dey detain Emefiele to dey find evidence against am.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x