EFCC arrest Senator Rochas Okorocha for inside Abuja

Economic and Financial Crimes Commission don arrest Senator Rochas Okorocha after gbege wey shele for the former Imo State Governor house for inside Abuja.

Reports tok say EFCC operatives been arrest Senator Okorocha around 6:48PM yesterday, after dem break down security door wey de for him mansion.

EFCC tok say dem arrest Senator Okorocha sake of say, him jump bail plus him no still come court on top allegiate of two point nine-billion-naira wuru-wuru.

Early early, Senator Okorocha, wey also be presidential aspirant under APC, claimed say EFCC de hold am hostage make him for no partake for presidential screening.

Okorocha lawyer, Ola Olanipekun come still come out claim say, EFCC no send any invitation for him client or any warrant of arrest.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x