EFCC lawyer dey call for investigation into Abdulrasheed Bawa suspension

Long time lawyer of di Economic and Financial Crimes Commission, Wahab Shittu don call for thorough investigationand fair hearing for di case against di suspended EFCC chairmo, Abdurasheed Bawa.

Shittu tok se the reason na be se some pipu don already dey look Bawa suspension as case of corruption wey dey fight am back or se him no fit into di agenda of di current administration.

The Senior Advocate of Nigeria still tok se him dey worry about di frequent removing of EFCC chairmo dem, based on allege of corruption wey him tok se no dey go well wit Nigeria image for di international community.

Wahab Shittu dey tok this one based on di recent developments for di country since Presido Bola Ahmed Tinubu assume office two weeks ago.

Shittu tok se him get confidence se di Tinubu administration go succeed based on se him don start well.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x