EFCC say dem go appeal their chairmo conviction

Economic and Financial Crimes Commission don tok say dem go appeal their Chairmo wey be Abdulrasheed Bawa conviction sake of say him disobey court order.

The anti-corruption agency tok tok person, Wilson Uwujaren, tell tori people say the Commission go appeal the ruling.

You fit remember say one High Court wey sit for Abuja convict EFCC Chairmo, Abdulrasheed Bawa sake of say the commission no obey court wey direct them to return one Range Rover plus the sum of forty million naira to the person wey carry dem come court.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x