Ganduje plus Atiku congratulate Tinubu

Kano State Governor, Abdullahi Ganduje, don congratulate Bola Tinubu for him victory for the APC presidential primary.

Ganduje tok say as Tinubu comot so as flagbearer for APC say na victory for Nigeria, him come still add say Tinubu get the capacity to provide the kind leadership wey the country need.

For him side, the presidential candidate for People’s Democratic Party wey be Atiku Abubakar, don still congratulate Bola Tinubu on top him victory for the APC presidential primary.

The former Oga Vice Presido come still go him social media pages to take congratulate the former Lagos State Governor of Lagos State, him still tok say the APC presidential primary na one big and strong contest.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x