INEC dey fault Labour Party for se dem call out Professor Yakubu Mahmoud

Di Independent National Electoral Commission don see fault for why Labour Party dey call for di suspension and trial of em Chairmo, Professor Mahmoud Yakubu, becos of di conduct of di 2023 presidential election.

Di Chief Press Secretary to di INEC Chairmo, Rotimi Oyekanmi tok se di demand of di LP based on di European Union Observer report dey misplaced and ridiculous.

Oyekanmi dey remind LP se e nor dey within di rules of engagement for election observer groups wey INEC engage to indict anybodi.

Him tok se  Labour Party nor get di powers to demand for di dismissal and prosecution of di INEC Chairmo over di outcome of any persin wey the party parade as candidates.

The INEC official advise di LP to restrict itself to activities wey dem permit under di rules and regulations wey dey govern di conduct of political parties INEC register.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x