Jandor don announce Funke Akindele as PDP governorship running mate for Lagos

Lagos governorship candidate for the Peoples Democratic Party, Olajide Adediran wey most people know as Jandor don announce Nollywood actress, Funke Akindele as him running mate.

This one dey happen days after Funke marriage with him husband Jjc Skillz scatter.

Jandor wey tok this one for one statement, say Funke wey come from Ikorodu and Lagos East Senatorial District go get plenty votes during the governorship election.

Akindele wey still confirm the nomination, say she go work hard for PDP make dem win the election for Lagos State.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x